Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Ezra 9:1 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

1 Afta dem don do all dis tins finish, some among Israel leaders kom meet and tell mi, Di pipol, di priest and Levi pipol neva separate demsef from di pipol wey dey di kountries wey near dem. Dem still dey do tins with Ammon, Moab, Egypt, Kanaan, Hit, Periz, Jebus and Amor pipol. Dem dey do di same yeye tins wey doz pipol dey do.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Ezra 9:1
37 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

For di fourt generashon, yor shidren go kom back to dis place, bikos Amor pipol sin neva plenty rish.”


Solomon kon love many wimen wey kom from oda kountry. Apart from Fero pikin wey bi en wife, e still marry plenty wimen from Hit, Moab, Ammon, Edom and Sidon kountries.


E sin like di oda kings and nashons wey God porshu komot di land for Israel pipol.


For dis time, many pipol wey nor bi Israel pipol still dey di land afta Joshua don win Hit, Amor, Periz, Hiv and Jebus pipol.


Den Shekanaya wey bi Jehiel pikin wey kom from Elam family kon tell Ezra, “Wi nor dey faithful to God, bikos wi go marry doz strenj wimen, but even with dat, Israel still get hope.


Anybody wey nor kom before three days finish, dem go seize all en propaty and e go luz en rite as memba for di kommunity.


For dat time, I notis sey many among Jew men marry wimen from Ashdod, Ammon and Moab town.


Tobaya wey kom from Ammon stand near am kon sey, “Even fit fox waka on-top di wall wey dem build, na wons di wall go fall rish groun!”


Sanballat, Tobaya with Arab, Ammon and Ashdod pipol kon dey vex well-well wen dem hear sey wi still dey ribuild Jerusalem wall and kover all di holes wey dey.


Dem don already separate demsef from all di strenjas. Dem wear sak klot kon pak dust for dia head as sign sey dem dey sorry. Den dem kon stand dey konfess dia sins wey dem and dia grand-grand papa don kommit.


Instead, dem bigin make friends with pipol wey nor know God kon dey follow dia wiked ways,


Afta God don take una enter Kanaan, Hit, Amor, Hiv and Jebus pipol land; di place wey E promise una grand-grand papa sey E go give dem, land wey good well-well, den una go dey celebrate dis feast for di first mont for evry year.


My angel go-go for una front till una rish Amor, Hit, Periz, Kanaan, Hiv and Jebus pipol land and I go distroy dem for una.


How I go take know sey I dey good for yor eye, both mi and yor pipol, Israel? Nor bi if Yu go with us (dat is, mi and yor pipol), wi go dey difren from all di oda pipol for di world?”


All of una wey dey karry di temple tins, make una know sey God go save una from Babilon. So make una nor tosh anytin wey dem dey forbid; make una make unasef holy, so dat una nor go die.


Wen di leaders hear wetin happen, dem rush kom di temple from di royal palis. Dem kon form one kourt for where di New Gate for God temple dey.


Den di leaders and di pipol kon tell di priests and di profet sey, “Na God name dis man take tok to us, so make wi nor kill-am.”


Make una nor do wetin una do for Egypt where una dey before or for Kanaan land wey I go soon give una or do wetin dia law tok.


Judah pipol don break dia promise wey dem make with God kon dey do wiked tins for Jerusalem and evriwhere for di land. Dem don dirty di temple wey God love and dia men marry wimen wey dey serve juju.


I dey si dem from where I stand on-top di rock; I dey look dem from di hill. Dem bi one nashon wey dey stay alone; dem know sey dem dey bless pass oda nashon.


At wons, one Israel man bring one Midian woman enter di tent where Moses and di whole kommunity for dey kry.


Wen una enter di land wey di Oga una God dey give una, make una nor learn wetin di oda kountries for der dey do.


Di third generashon for Edom and Egypt pipol fit enter God present.


Wen di Oga una God take una enter di land wey una go-go stay, E go porshu many kountries komot for una. Kontries like: Hit, Girgash, Amor, Kanaan, Periz, Hiv and Jebus pipol. (Di pipol for dis seven kountries get pawa pass una.)


“If una turn from God kon go enter agriment with di remainin towns wey dey near una, den marry some of dem and bi friend with some,


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ