So make una guide dem with kare until una rish di temple. If una rish di priest room, make una measure dem kon give dem to di priests, Levi pipol, Israel and Jerusalem leaders.
Den wi kon go di temple for di fourt day, measure di gold, silva and di oda tins kon gi-am to Priest Meremot wey Uriaya born. Eleazar wey bi Finehas pikin and two Levi pipol; Jozabad wey Jeshua born and Noadaya wey Binnui born, dey der with am.
All di pipol wey kom back from Babilon bring ofrin wey dem won sakrifice give Israel God. Dem offa 12 bull for Israel pipol, 96 ram and 77 lamb; dem still offa 12 goat to klean demsef from sin. Dem burn all dis animals as sakrifice give God.