Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Ezra 8:31 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

31 Na for di twelft day for di first mont naim wi komot from Ahava River kon start to go Jerusalem. Awa God dey with us and E protet us from enemies make dem nor attack and set trap for us as wi dey travel.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Ezra 8:31
10 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

E still don let mi get favor from di king, en advisers and en ofisas wey get pawa well-well. Di Oga my God don give mi strent so I gada leaders among Israel pipol for Babilon wey go follow mi go back to Jerusalem.


and with God help, dem rish Jerusalem for di first day for di fift mont.


I gada dem for di river wey dey rush go Ahava Town and wi stay der for three days. I si sey some priests dey among di pipol, but Levi pipol nor dey.


Wen una si sey dis tins dey happen, una heart go happy and una go prosper like grass. Den una go know sey, ‘Mi wey bi God dey help pipol wey obey mi, but I dey vex for my enemies.’ ”


Dem beg am make e give orda sey make dem bring Paul kom Jerusalem back, bikos dem plan to attack and kill-am for road.


But God don dey help mi till today, so I stand dey tell evribody, weda dem bi small pikin or big pesin. So, wetin di profets and Moses tok sey go happen, naim I dey tell una so,


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ