2 Gershom from Finehas family; Daniel from Itama family; Hattush (Shekanaya pikin) from David family;
Dis na shidren wey dem born for David wen e dey Hebron: Di first pikin na Amnon, en mama na Ahinoam wey kom from Jezrel: di sekond one na Daniel, en mama name na Abigail, wey kom from Karmel.
Shekanaya born only Shemaya and Shemaya sons na: Hattush, Igal, Baraya, Nearaya and Shafat. All of dem na six.
Dis na di leaders wey bi prisonas for Babilon and wey follow Ezra go back to Jerusalem, wen Atazazes bi king:
I gada dem for di river wey dey rush go Ahava Town and wi stay der for three days. I si sey some priests dey among di pipol, but Levi pipol nor dey.