16 I kon sey make dem go koll nine leaders kom and dem bi: Elieza, Ariel, Shemaya, Elnatan, Jarib, Elnatan, Natan, Zekaraya and Meshullam and two tishas wey bi Joiarib and Elnatan.
Hiram still sey, “Na di Oga God for Israel deserve all di praiz, bikos na-im make di sky and di eart! E don give David one pikin wey wise and undastand sey e suppose build temple for God, plus royal palis for ensef.
I send dem go meet Iddo, di kommunity leader wey dey Kasifaya, make dem ask en and en ofisas, doz wey dey work for di temple, so dat dem go send some pipol kom wey go serve God for di temple.
Bikos di good God hand dey with us, dem kon send Sherebaya, one strong man from Levi tribe for Mahli family and 18 of en sons and brodas follow am kom.
Wi know sey God Pikin don kom and e don give us sense to know di trut about God. And wi dey inside en Pikin Jesus Christ. Na-im bi di real God and na-im bi di life wey nor go end.