Just like di leaders for Aaron family, dem divide dia work give dem with dice wey dem trow without sey dem use age or rank. King David, Zadok, Ahimelek, di priests and di leaders for Levi tribe dey der and dem do evritin for dia front.
King David choose 2,700 men from Jeriaya relashon wey pipol dey respet well-well kon sey make dem dey lead Reuben tribe, Gad tribe and half of Manasseh tribe. Na dem dey judge any matter wey koncern God and di king.
Dem still stay for all di small-small village wey dey near dis towns go rish Baal. Na where dem stay bi dat and dem rite and keep all dia family history.
Di head for each family for Judah and Benjamin tribe, di priests, Levi pipol and evribody wey God tosh dia heart kon go back to Jerusalem go build God Temple.
Dia leaders na Zerubabel, Jeshua, Nehemaya, Seraya, Reelaya, Mordekai, Bilshan, Mispar, Bigvai, Rehum and Baanah. Dis na di list and di nomba of pipol from each family for Israel wey kom back from Babilon:
E still don let mi get favor from di king, en advisers and en ofisas wey get pawa well-well. Di Oga my God don give mi strent so I gada leaders among Israel pipol for Babilon wey go follow mi go back to Jerusalem.
For di sevent year wey Atazazes dey rule, Ezra komot from Babilon go Jerusalem with some Israel pipol and some among dem na priests, Levi pipol, doz wey dey sing for di temple, temple guards and workers.