E still don let mi get favor from di king, en advisers and en ofisas wey get pawa well-well. Di Oga my God don give mi strent so I gada leaders among Israel pipol for Babilon wey go follow mi go back to Jerusalem.
Bikos di good God hand dey with us, dem kon send Sherebaya, one strong man from Levi tribe for Mahli family and 18 of en sons and brodas follow am kom.
I dey shame to ask di king make e give us some sojas wey go guide us from awa enemies as wi dey travel, bikos I tell am sey, Awa God dey bless anybody wey trust am, but E dey ponish and vex with anybody wey turn from am.
Na for di twelft day for di first mont naim wi komot from Ahava River kon start to go Jerusalem. Awa God dey with us and E protet us from enemies make dem nor attack and set trap for us as wi dey travel.
I tell dem how God help and dey with mi. I still tell dem evritin wey di king tell mi. Di pipol ansa, “Make wi start to ribuild di wall!” So dem kon ready to start di work.
I still ask di king make e give mi leta wey I go give Asaf wey dey guide di royal forest, so dat e go give mi big-big woods make I take build di guide gate for di temple, di town wall and di house wey I go stay. So di king give mi all wetin I wont, bikos God dey with mi.
Wen una si sey dis tins dey happen, una heart go happy and una go prosper like grass. Den una go know sey, ‘Mi wey bi God dey help pipol wey obey mi, but I dey vex for my enemies.’ ”