Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Ezra 7:25 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

25 As for yu Ezra, make yu use di wisdom wey yor God give yu, take choose ofisas and judge wey dey obey God and na dem go rule di pipol for West Eufrates. Yu must tish evribody wey nor know di law.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Ezra 7:25
30 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

So Fero kon ask en ofisas, “Wi go fit si anoda pesin wey bi like Josef, pesin wey God Spirit dey with?”


So Fero tell Josef, “Bikos God don make yu know all dis tins, e nor get anybody wey wise and good like yu!


Wen Israel pipol hear how Solomon take judge di kase, all of dem kon dey respet am, bikos dem know sey na God gi-am di wisdom wey e take dey judge well.


So Assyria king ansa, “Make una go bring one among di priest wey wi take from der kom. E go stay der kon tish us wetin God wont for di land.”


Make di Oga wey bi yor God give yu wisdom to take rule Israel, just as E tok.


Di king choose 24,000 wey go do di temple work; 6,000 wey go dey rite and judge kase;


So make yu get up, bikos na yor rite to take akshon. Wi dey yor back, so go do as yu fit sey God wont.”


Den King Darius ansa: To Tattenai, di govnor for West Eufrates, Shetar-Bozenai and una ofisas for der, make una nor go near di temple


Ezra main work na to dey study God law, pratise am and tish Israel pipol how to obey God.


Mi and my seven advisers dey send yu go shek wetin dey happen for Jerusalem and Judah and to si weda dem dey obey yor Oga God law wey dey yor hand.


Dem read di Oga dia God law for dem for like three hour, den dem konfess dia sins kon woship di Oga dia God for di next three hours.


God laws dey korrect and e dey save life. Di laws wey God give us na trut and dem dey give wisdom to pipol wey ready to learn.


Na God dey give wisdom! Na from en mout knowledge and undastandin dey from kom.


Wetin dem sey make yu do, bi like lite and dia korreshon go fit tish yu how to live yor life.


Na priest work to tish di trut about God. So make pipol go meet and learn wetin I wont from dem, bikos na Oga God send dem.


Den Jesus kom tell dem, “Anybody wey dey tisha di law and e bi disciple for God Kingdom, go bi like pesin wey get house kon bring new and old tins kom out from inside di house.”


Wen Jesus kom down from di boat, e si plenty pipol and e kon sorry for dem, bikos dem bi like animal wey nor get who dey look afta dem. So e kon tish dem many tins.


For all di towns wey di Oga una God dey give una, make una pick doz wey fit judge from each tribe for Israel. Di judge dem must judge di pipol well.


As wi dey tell evribody wetin dem go do, wi dey prish Christ and tish with wisdom, so dat wen wi go show una to Christ, una go don dey pafet.


But if anybody nid wisdom, make e ask God wey dey gi-am to evribody. E nor go sey, “No,” but E go give yu.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ