Dem go karry dem go Babilon until di day wey I go remember dem. Den, I go bring una kom back kon give una evritin wey una don lost for dis place. Mi, wey bi God, don tok.” ’ ”
Wen dat time rish, pipol go know Jerusalem as ‘God Throne’ and all di nashons go gada kom woship mi for der. Dem nor go do wetin dia sturbon and wiked heart sey make dem do again.