16 Make yu still take all di gold and silva wey yu fit kollect from Babilon and di ofrin wey Israel pipol and dia priests give for dia Oga God Temple for Jerusalem.
I know sey Yu dey test evribody heart and Yu dey like doz wey dey respet diasef. I put my body for groun kon use all my heart take give Yu all dis tins and I don si how all yor pipol dey happy as dem dey give Yu dia gifts.
Imnah pikin Kore, wey kom from Levi tribe, dey guide di east side for di temple and na-im still dey kollect and divide di gifts wey pipol bring kon give God.
E tell David sey, ‘Since di day I take my pipol komot from Egypt, I nor choose any town from all di tribe for Israel wey go build di temple wey I go stay or sey I choose one man as pesin wey go lead my pipol Israel.
Anywhere wey Israel pipol still remain, make dia neighbours help dem. Make dem give dem silva, gold, animals and ofrin wey dem go offa for God Temple for Jerusalem.