Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Ezra 7:14 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

14 Mi and my seven advisers dey send yu go shek wetin dey happen for Jerusalem and Judah and to si weda dem dey obey yor Oga God law wey dey yor hand.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Ezra 7:14
15 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Make God dey with all of una wey bi en pipol as una dey go Jerusalem go ribuild di Oga wey bi Israel God house and na-im una go woship for Jerusalem.


Awa oga, wi wont make yu know sey wi go Judah aria kon si sey dem dey build di great God Temple with big-big block kon use iron wood take do pilas for di wall. Dem dey do di work with kare and e dey go well.


Make di God wey choose Jerusalem as di place where dem go for woship am ova-trow any king or nashon wey nor obey dis kommand or won try distroy di temple. Mi, Darius don kommand and una must obey my kommand go rish di end.


I kommand una naw sey, make una help dem ribuild di temple. Di palis go use di tax wey dem kollect from West Eufrates take pay for evritin, so dat nor-tin go stop di work.


Yu go take di gold and silva ofrin follow body, bikos na mi and my seven advisers won gi-am to Israel God, wey en temple dey Jerusalem.


E still don let mi get favor from di king, en advisers and en ofisas wey get pawa well-well. Di Oga my God don give mi strent so I gada leaders among Israel pipol for Babilon wey go follow mi go back to Jerusalem.


So I measure di gold, di silva and di oda tins wey di king, en advisers, ofisas and Israel pipol give make dem use for di temple kon give dem to di priests.


Di pipol wey e dey always koll for advise na: Karshena, Shetar, Admata, Tarshish, Meres, Marsena and Memukan and dem bi seven ofisas for Persia and Media wey get di highest pozishon for di kingdom.


Den make una remember God kommand and evritin wey di profets sey go happen. True-true, all di pipol wey dey si vishon, dey tok all dis tins, bikos dia mind dey dark.


Di king sey, “Na yor God big pass among all gods! Na-im bi God of all kings and E dey show pipol wetin dey sekret and na-im make yu fit tok all dis tins so!”


As e rish der, e kon shaut, “Daniel, God wey nor dey die savant! Di God wey yu dey serve fit save yu?”


I dey kommand sey, ‘Make evribody wey dey dis kingdom, fear and respet only Daniel God.’ “E go rule forever, bikos E nor dey die. Dem nor go fit distroy en kingdom and en pawa nor get end.


“Make yu take Heldai, Tobaya and Jedaya wey kom back from Babilon with di oda pipol, den go meet Josaya wey bi Zefanaya pikin for en house.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ