Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Ezra 7:10 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

10 Ezra main work na to dey study God law, pratise am and tish Israel pipol how to obey God.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Ezra 7:10
30 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

God wey bi awa grand-grand papa Abraham, Isaak and Jakob God, make yor pipol always dey ready to obey Yu forever, so dat Yu go always make dem dey faithful to Yu.


E sin against God bikos e nor gri serve am with en whole heart.


But yu don still do some good tins before. Yu remove Asherah juju from di town and yu really won follow God.”


King Hezekaya show sey e happy well-well as Levi pipol use all dia mind dey serve God. Dem do di feast for seven days, dey give ofrins and dey tank God wey bi dia grand-grand papa God.


King Atazazes give dis leta to Ezra wey bi priest, wey sabi read and know evritin about di law and kommand wey God give Israel pipol:


As for yu Ezra, make yu use di wisdom wey yor God give yu, take choose ofisas and judge wey dey obey God and na dem go rule di pipol for West Eufrates. Yu must tish evribody wey nor know di law.


Ezra go skool and e know di law wey di Oga wey bi Israel God give Moses, well-well. Bikos God dey with Ezra, di king dey gi-am evritin wey e ask for.


But for yu Job! Make yor heart dey rite before yu koll God.


Instead, e dey always dey happy to obey God kommand and na both for day and nite, e dey study dem.


Oga God, na Yu bi di hope wey poor pipol get. True-true, Yu go hear dia kry kon konfort dem.


and I dey ready to keep wetin Yu tok till I die.


I go dey save, bikos na only yor kommand I dey follow.


God laws dey korrect and e dey save life. Di laws wey God give us na trut and dem dey give wisdom to pipol wey ready to learn.


My God, I get hope. Yes! I get hope. So I go sing kon praiz yor name.


Na priest work to tish di trut about God. So make pipol go meet and learn wetin I wont from dem, bikos na Oga God send dem.


So anybody wey nor do wetin God kommand and dey tish odas to do as e dey do, naim go small pass for God Kingdom. But pesin wey obey God and tish odas to do wetin di Law tok, na big pesin e go bi for God Kingdom.


“Pesin wey hear my word and do wetin I tok, e bi like wise man wey build en house on-top rock.


Since una know wetin I dey tok, God go bless una, if una do dem.


My friend Teofilus, for di book wey I first rite give yu, I tok about all di tins wey Jesus Christ start to dey do and tish,


Make una remember sey na slave una bi for Egypt before, so make una obey all dis kommand with kare.


Dem go tish Jakob yor law kon tish Israel pipol yor kommand: dem go offa betta incense for Yu kon burn good ofrin for yor altar.


Leader for church must bi pesin wey nor get fault; wey get only one wife; fit kontrol ensef; get sense and respet; dey welkom pipol and e bi good tisha.


Make yu dey prish God word and dey ready, weda di time dey okay or not. Make yu use patient take korrect and enkourage yor pipol with betta tishing.


But for yu Titus, yu must tish pipol how to bihave well.


Make yu tish dem dis tins and korrect dem with boldness. So, make yu nor let anybody trit yu like small pikin.


God don bless doz wey wosh dia klot klean, so dem go get authority to chop from di tree wey dey give life and dem go fit pass di gate enter di town.


Samuel kon tell Israel pipol, “If una don really turn from sin kom meet God with all una heart, make una remove all di small-small Ashtoret gods wey una get. Make una give una heart to God kon serve only en. Den E go save una from Filistia pipol pawa.”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ