Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Ezra 6:6 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

6 Den King Darius ansa: To Tattenai, di govnor for West Eufrates, Shetar-Bozenai and una ofisas for der, make una nor go near di temple

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Ezra 6:6
14 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Den di man sey, “Dem nor go koll yu Jakob again, but from today go, na Israel dem go dey koll yu, bikos yu don fight with God and man and yu don win.”


Make di God wey get pawa give una mesi for di man front, so dat e go release Simeon and Benjamin! But for mi, if I luz my shidren, I luz dem bi dat.”


“From Rehum wey bi di govnor and Shimshai di aria seketry; from di judge dem and all di ofisas from Erech, Babilon and Shushan wey dey Elam land,


At wons, govnor Tattenai for West Eufrates, Shetar-Bozenai and dia ofisas kom Jerusalem kon ask: Who orda una sey make una start to ribuild dis temple and komplete am?


Dis na di ripot wey dem send go give di king:


Den govnor Tattenai, Shetar-Bozenai and dia ofisas kon do evritin wey di king kommand.


and nor tok as dem dey build am. Make una allow di govnor for Judah and di leaders ribuild God Temple as e bi before.


Make Yu listin to di prayers wey mi and yor savants wey dey honor Yu, dey pray. Make Yu help mi today, so dat di king go sorry for mi.” For dat time, na mi dey serve di king wine.


True-true, di way Yu dey vex judge human being, go make dem praiz Yu. Yu really dey show as Yu dey vex rish.


Evry king heart dey God hand; just as E dey show river how e go take flow, na so too E dey kontrol kings mind.


Yor wisdom, brain and undastandin nor mean anytin if God dey against yu.


No, but God vex for en pipol kon send dem go Babilon as dia ponishment. E karry dem komot from dia land with one strong breeze from di east.


Wetin wi go tok about all dis tins? If God dey for awa side, who go fit dey against us?


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ