Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Ezra 6:5 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

5 Make dem still riton all di gold and silva tins wey King Nebukadnezzar karry from di temple for Jerusalem kom Babilon. Make dem put dem for God temple, di place where dem dey before.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Ezra 6:5
12 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

All di good and betta tins wey dey di royal palis and di temple, King Nebukadnezzar pak all of dem. All di gold tins wey King Solomon for Israel make put for God Temple, King Nebukadnezzar remove all of dem, just as God tok.


Wen di year just start, King Nebukadnezzar kon give orda sey make dem bring am with di betta tins wey dey for God Temple kom Babilon. E make Zedekaya wey bi en family memba, king for en place for Jerusalem.


Di king karry all di tins wey dey God Temple go Babilon; weda di tins big or small, plus all di tins wey dem keep for God Temple, Israel kings and en ofisas store room.


E riton di gold and silva tins (wey Nebukadnezzar take from di temple for Jerusalem go put for en own temple for Babilon). King Cyrus riton di tins give one man wey dem dey koll Sheshbazzar, wey e choose as govnor for Judah.


Den I tell di priest and di pipol: “God sey: ‘Nor listin to di profets wey sey dem go soon bring all di betta-betta tins for di temple kom back from Babilon. Dem just dey lie give yu.


Dem take evritin wey dem make with gold and silva: di small basin; di shako pans; di sakrifice blood basin; di ash kontaina, di lampstand, di burnt incense basin and di wine basin.


God allow King Nebukadnezzar katch King Jehoiakim and e karry some of di tins wey dey God temple too. E karry Judah pipol as prisonas go Babilon and di tins wey e karry from Jerusalem, e put dem for en own juju temple.


As dem dey drink, King Belshazzar orda sey make dem bring all di gold, silva and bowl wey en papa Nebukadnezzar karry kom from God temple for Jerusalem. Di king sey make dem bring dem kom, so dat en, en ofisas, en wife and girl-friends go use dem drink wine.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ