Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Ezra 6:14 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

14 Jew leaders kon dey progress well-well as dem dey build di temple, wey profet Haggai and Zekaraya enkourage dem to build. Dem komplete di temple, just as Israel God, King Cyrus, King Darius and King Atazazes for Persia kommand sey make dem do.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Ezra 6:14
25 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

So dem start work for di sekond mont for di year afta dem kom back to Jerusalem where di temple dey. Zerubabel wey Shealtiel born, Jeshua wey Jozadak born, plus all di pipol, di priests and Levi pipol wey kom back from Babilon kon join do di work. Dem put Levi pipol wey don rish twenty years or wey don old pass dat age small make dem dey supavise di work.


So dem stop to build di temple until di sekond year wen King Darius dey rule for Persia.


Den Zerubabel, Jeshua and di leaders kon tell dem, “Wi nor nid una help to ribuild di Oga awa God Temple. Wi go build am by awasef, just as King Cyrus for Persia sey make wi do.”


Dat time, two profet wey dia name bi Haggai and Zekaraya wey Iddo born kon start to prish with Israel God name give Jew pipol wey dey stay for Judah and Jerusalem.


Den for di first year wen King Cyrus dey rule for Babilon, e kon orda sey make wi go ribuild di temple.


Wen Zerubabel, Shealtiel pikin and Jeshua wey Jozadak born hear dia message, dem kon start to ribuild di temple for Jerusalem and di two profet help dem.


For di first year wen King Cyrus dey rule, e kommand sey make dem ribuild di temple for Jerusalem as di place where dem for go dey offa sakrifice and burnt ofrin. E sey, make di temple high and wide rish ninty-nine fit.


I kommand una naw sey, make una help dem ribuild di temple. Di palis go use di tax wey dem kollect from West Eufrates take pay for evritin, so dat nor-tin go stop di work.


Afta all dis tins don happen, for di time wen King Atazazes dey rule Persia, one man wey en name na Ezra kon kom from Babilon. E trace en grand-grand papa family kon know sey e kom from Aaron, di High Priest family. Ezra na Seraya pikin and na Zabud wey Hilkaya born, bi Seraya papa.


Even doh wi bi slave before, Yu nor leave us as slave. Yu make Persia king favor us kon allow us go ribuild yor temple wey skata and make wi wey dey Judah and Jerusalem get peace.


Afta wi don work for fifty-two days, wi finish di hole wall for di twenty-fifth day for Elul (October) mont.


Na mi tell Cyrus sey, ‘Na yu bi di pesin wey go rule; yu go do wetin I wont make yu do. Yu go orda make dem build Jerusalem again kon ribuild di Temple.’ ”


For di sekond year wen Darius bi king for Persia; for di first day for di sixt mont, God tell Profet Haggai make e give dis message to Zerubabel, Shealtiel pikin, wey bi govnor for Judah and to Joshua, Jehozadak pikin, wey bi di High Priest.


So, make una go di mountins go kut wood kon ribuild di temple; den I go dey happy and belle go sweet mi.” Dis na wetin Oga God tok.


For di eight mont for di sekond year wey Darius dey rule for Persia, God give dis message to Profet Zekaraya, Berekaya pikin wey Iddo bi en grand-papa.


“ ‘So I don kom back to Jerusalem town kon show dem mesi. Dem go build my temple and di town again.’ ”


“Na Zerubabel start di temple foundashon and na-im go komplete am. Dat time, una go know sey na Oga God send mi kom.


God wey dey lead heaven sojas sey, “Make una dey strong kon finish di work! Na since dem start to build God Temple, una don hear wetin di profets dey tok about how di temple work go take komplete.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ