make yu orda make dem search for di rekord wey yor grand-grand papa keep. If yu do am, yu go si sey, before-before, di town too like wahala and e don give kings, kingdoms and rulers, many trobol. Di pipol for der, dey hard to rule and na dis make dem distroy di town.
I don orda sey make dem find out and dem sey, na true sey Jerusalem dey go against royal authority before; na so-so trobol dem dey find and pipol wey nor dey obey di law, full der.
Naw, awa oga, if yu like, make yu orda for di royal rekord for Babilon weda yu go si if King Cyrus really give orda sey make dem ribuild di temple for Jerusalem and den, make yu tell us wetin yu si for dis matter.”
Dem happy well-well as dem dey celebrate di Bread wey nor get Yist Feast, for seven days. Belle sweet dem well-well, bikos God shange Assyria king karata and e kon support dem as dem dey ribuild Israel God Temple.
God sey make I tell di king: “Yu don burn di book kon dey ask Jeremaya, ‘Why yu sey Babilon king go kom distroy dis land, kill evribody and all di animal?’
So, I take anoda book kon gi-am to my seketry, Baruk and e rite evritin wey I tell am. E rite evritin wey dey di first won kon add some oda ones wey I sey make e rite, join am.
“So make yu know and undastand sey, ‘From naw wen I tell yu dis message, till di time wen dem go ribuild Jerusalem and di leader wey God choose go kom, e go bi seven weeks and sixty-two weeks. Dem go build di town well again, but wahala go dey for dat time.