Wi wont make di king know sey Jew pipol wey kom from yor oda aria, don dey stay for Jerusalem and dem dey build dat evil and yeye town back. Dem don start to build di wall and go soon finish am.
Awa oga, wi wont make yu know sey wi go Judah aria kon si sey dem dey build di great God Temple with big-big block kon use iron wood take do pilas for di wall. Dem dey do di work with kare and e dey go well.