7 “To King Darius, make peace dey yor kingdom.
Di King kon ansa dem: “To Rehum di govnor; Shimshai di aria seketry; doz wey dey stay Samaria and di remain part for West Eufrates: I dey greet una.
Dis na di ripot wey dem send go give di king:
Awa oga, wi wont make yu know sey wi go Judah aria kon si sey dem dey build di great God Temple with big-big block kon use iron wood take do pilas for di wall. Dem dey do di work with kare and e dey go well.
So, dem tell King Nebukadnezzar, “Awa king, make yu live forever!
King Nebukadnezzar send message go meet all di pipol for Babilon sey: “Make e betta for una!
Daniel kon ansa di king from di pit, “My king, yu go live forever!
Make una mind rest, bikos na my peace I give una. My peace difren from di one wey di world dey give. Make una nor fear or allow anytin worry una mind.
Naw, make Christ wey dey give peace, give una en peace evritime and make di peace dey with una always.