Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Ezra 5:16 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

16 So Sheshbazzar kon lay di foundashon and na since den wi don dey ribuild, but wi neva fit finish am.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Ezra 5:16
11 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Wen di men start di temple foundashon, di priests wear dia garment, stand for dia pozishon kon hold dia trumpet for hand. Levi pipol wey kom from Asaf family still stand der too with dia cymbals. Dem praiz God akordin to wetin dem rite down for King David time.


So dem start work for di sekond mont for di year afta dem kom back to Jerusalem where di temple dey. Zerubabel wey Shealtiel born, Jeshua wey Jozadak born, plus all di pipol, di priests and Levi pipol wey kom back from Babilon kon join do di work. Dem put Levi pipol wey don rish twenty years or wey don old pass dat age small make dem dey supavise di work.


E riton di gold and silva tins (wey Nebukadnezzar take from di temple for Jerusalem go put for en own temple for Babilon). King Cyrus riton di tins give one man wey dem dey koll Sheshbazzar, wey e choose as govnor for Judah.


Di king sey make e put di tins back for di temple for Jerusalem and ribuild di temple for where e bin dey.


Wen Zerubabel, Shealtiel pikin and Jeshua wey Jozadak born hear dia message, dem kon start to ribuild di temple for Jerusalem and di two profet help dem.


Dem finish di temple for di third day for Adar mont (First mont) for di sixt year wen King Darius dey rule.


But from today wey bi di twenty fourt day for di ninet mont, make una tink about how e bi before and naw wen una don build di temple again. Make una always dey tink of am.


Make una nor laf as una take start small, bikos God dey happy sey di work don start and E dey happy to si di ruler for Zerubabel hand.” (Di seven lamps na God eyes wey dey look di whole world.)


“Na Zerubabel start di temple foundashon and na-im go komplete am. Dat time, una go know sey na Oga God send mi kom.


Den di Jew oga dem tell am, “Na forty-six years dem take build dis Temple and yu dey sey yu go fit build am for three days?”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ