Dis na wetin King Cyrus for Persia tok, Di Oga God for heaven don make mi rule di whole world and E sey make I build temple for am for Jerusalem wey dey Judah.
Even doh di pipol wey kom back from Babilon dey fear doz wey dey di land, dem still build di altar put for where e dey before. So dem start to burn di normal morning and evening sakrifice for der.
E riton di gold and silva tins (wey Nebukadnezzar take from di temple for Jerusalem go put for en own temple for Babilon). King Cyrus riton di tins give one man wey dem dey koll Sheshbazzar, wey e choose as govnor for Judah.
For di first year wen King Cyrus dey rule, e kommand sey make dem ribuild di temple for Jerusalem as di place where dem for go dey offa sakrifice and burnt ofrin. E sey, make di temple high and wide rish ninty-nine fit.