1 Dat time, two profet wey dia name bi Haggai and Zekaraya wey Iddo born kon start to prish with Israel God name give Jew pipol wey dey stay for Judah and Jerusalem.
Jew leaders kon dey progress well-well as dem dey build di temple, wey profet Haggai and Zekaraya enkourage dem to build. Dem komplete di temple, just as Israel God, King Cyrus, King Darius and King Atazazes for Persia kommand sey make dem do.
For di sekond year wen Darius bi king for Persia; for di first day for di sixt mont, God tell Profet Haggai make e give dis message to Zerubabel, Shealtiel pikin, wey bi govnor for Judah and to Joshua, Jehozadak pikin, wey bi di High Priest.
But from today wey bi di twenty fourt day for di ninet mont, make una tink about how e bi before and naw wen una don build di temple again. Make una always dey tink of am.
God wey dey lead heaven sojas sey, “Make una dey strong kon finish di work! Na since dem start to build God Temple, una don hear wetin di profets dey tok about how di temple work go take komplete.