Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Ezra 3:7 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

7 So di pipol give money to take pay doz wey dey mold block with di karpenters. Dem send food, drink and olive oil go Tyre and Sidon, so dat dem go give dem cedar trees from Lebanon. Dem karry di trees pass Joppa wotaside and na King Cyrus for Persia allow dem do all dis tins.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Ezra 3:7
20 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

King Hiram for Tyre kon send business men go meet David, e send cedar woods with karpenters and doz wey dey do stones go meet David make dem take build di palis.


So make yu send yor men go Lebanon go kut cedar wood for mi. My men go work with dem and I go pay yor men any prize wey yu tok. Yu know sey my men nor sabi kut trees like yor men.”


Wen dem si sey di box don full, di royal seketry and di High Priest go kount and keep di money.


Di money wey dem bring kom God Temple, dem nor use am for silva bowl, wetin dem take dey burn incense, basins, trumpets or anytin wey bi gold or silva.


Dem kon give di money to di three men wey dey ripair di temple wey


Aldo di pipol neva start to ribuild di temple, but dem start to burn sakrifice give God for di first day for di sevent mont.


Judah and Israel pipol dey buy goods from una with wheat, honey, olive oil and spices.


But Jonah kon plan to run go anoda place, bikos e nor won do wetin God tell am. E travel go Joppa where e for si one ship wey karry load dey go Tarshish. So e buy tiket kon enter di ship, so dat e go fit hide from God.


Herod kon dey vex well-well for Tyre and Sidon pipol. So dem gada go si am. But dem kon first beg Blastus wey bi di king offisa, make e help dem beg am, bikos na di king kountry dey supply food give dia kountry.


One woman dey for Joppa wey bi Jesus Christ disciple and en name na Tabita (wey mean Dorkas for Greek language). E dey do good tins and dey help poor pipol.


Bikos Lydda dey near Joppa, so wen di disciples hear sey Pita dey der, dem kon send two men go koll am sey, “Make yu kom meet us at wons.”


Pita kon stay for Joppa for many days with one man wey dem dey koll Simon, wey dey do leda work.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ