Imnah pikin Kore, wey kom from Levi tribe, dey guide di east side for di temple and na-im still dey kollect and divide di gifts wey pipol bring kon give God.
Wi, di pipol, di priests and Levi pipol, go trow dice evry year to know di family wey go dey burn di sakrifice wey dem offa give di Oga awa God, akordin to wetin dey di law.
Una go still give di wine ofrin with each sakrifice: two kwota of wine for each melu, three kwota for di ram and one kwota for each lamb. Make una dey do dis sakrifice for di first day for evry mont
Make una give burnt ofrin, di kind smell wey God like well-well, dat is: two yong melu, one ram and seven man lamb wey bi one year and dem must dey okay.
For di first day, una go give food ofrin to God, di smell wey God like well-well: una go give thirteen yong melu, two ram and fourteen man lamb wey bi one year and dem must dey okay.
Make una give burnt ofrin to God, di smell wey God go like: make una give one yong melu, one ram and seven man lamb wey bi one year and all of dem must dey okay.
“ ‘Dis na di law for burnt, grain, wine and fellowship ofrin wey una go give God wen una dey do di feast. Dis ones join di ofrin wey una go give to fulfil di vow or as free will ofrin.’ ”
But una must give burnt ofrin to God; di smell wey God dey like: una go give one yong melu, one ram and seven man lamb wey bi one year and dem must dey okay.