Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Ezra 3:1 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

1 For di sevent mont wey Israel pipol don dey stay for dia towns, all of dem kon gada for Jerusalem

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Ezra 3:1
16 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Wetin di remainin pipol give rish, 20,000 pound for gold, 2,000 pound for silva and 67 garment for di priests.


Di Priest, Levi pipol, doz wey dey guide di gate, doz wey dey sing, di temple savants and evry oda pesin for Israel kon stay for di town. So for di sevent monts, Israel pipol kon start to stay for dia towns.


All of dem gada for Jerusalem for one hall wey dey di Wota Gate front. Dem kon tell Ezra wey sabi di law sey make e go bring di Law Book wey God give Israel thru Moses.


Dem si sey, Moses rite for God Law sey, make Israel pipol stay for shelta wen ever dem dey do di feast for di sevent mont.


“Dis na di law wey una go obey forever. For di tent day for di sevent mont, Israel pipol and di strenjas wey dey stay with dem must fast and dem must nor do any work.


“Make yu tell Israel pipol sey, ‘For di first day for di sevent mont, una go rest well-well and una must kom togeda kon woship mi wen una hear di trumpet sound.


Make una know sey, for dat time, I go make di nashons praiz mi well-well. All of dem go dey pray with my name kon woship mi with one spirit.


Dem dey stay togeda evriday like one big family. Dem dey gada go di temple togeda and dem dey go from house to house, dey chop togeda with happiness.


All di pipol wey bilive Jesus Christ kon dey do tins togeda with one mind and nobody sey e go use wetin e get for ensef alone, so dem kon dey share dia propaty togeda.


My brodas and sistas, I dey beg una with awa Oga God Jesus Christ name sey, make una nor kworel, but make una get one mind for evritin wey una dey do.


For evry year, evry man for Israel go dey celebrate dis three feast: Bread wey nor get yist, Harvest Feast and Shelta Feast. For each feast, evribody must karry gift kom give di Oga una God for di place wey E choose.


Israel pipol for nort for Dan kountry go rish Beersheba for sout and even Gilead land for east, ansa di koll. Dem gada togeda as one for God present for Mizpa.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ