62 Since dem nor fit prove who dia grand-grand papa bi, dem nor kon asept dem as priest.
And di man stik wey I go choose go prosper; so I go stop Israel pipol to dey komplain against yu.”
But na yu and yor sons go do di priest work, evritin wey dey di altar and di Holy Place. And yu must work, bikos I don give yu di gift to bi priest and anybody wey I nor choose, if e kom near di holy tin, dem must kill-am.”
So yu go choose Aaron and en sons kon make dem do di work wey priests dey do; anybody wey try to do dia work for dem, make dem kill-am.”