Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Ezra 2:58 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

58 All di pipol wey dey work for di temple and Solomon savant shidren-shidren wey kom back, na 392.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Ezra 2:58
12 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Na Kanaan shidren-shidren Solomon use take do all dis work. Dis na di pipol wey Israel pipol nor kill wen dem kom out from Egypt kon take-ova Kanaan.


Doz wey kom from Ammon, Het, Periz, Hiv and Jebus dey too and dia shidren still bi slaves for Israel till today.


Doz wey first kom back to dia land na: di priests, Levi pipol, doz wey dey work for di temple and some few Israel pipol.


Shefataya, Hattil, Pocheret-Hazrebaim and Ami.


Dis na di ones wey kom from Tel-Melah, Tel-Harsha, Kerub, Addon and Imma (aldo dem nor fit show weda dem really kom from Israel tribe), di family na:


For di sevent year wey Atazazes dey rule, Ezra komot from Babilon go Jerusalem with some Israel pipol and some among dem na priests, Levi pipol, doz wey dey sing for di temple, temple guards and workers.


and di temple savants wey dey stay Ofel Hill ripair rish di aria wey dey opposite di Wota Gate for di east side and di towa wey dey guide di temple.


All di temple savants and Solomon savants shidren-shidren wey kom back na 392.


I hire both men and wimen savant and I still get savants wey dem born for my house. My animal and di pipol wey dey kare for dem, many pass any of di kings own wey don rule for Jerusalem before naw.


Di leaders still sey, “Make dem live.” So Gibeon pipol kon dey kut wood and karry wota for di whole kommunity, just as di leaders wont am.


Naw, una go bi awa savants forever and una go dey kut wood and karry wota go awa God house.”


and from dat day go, e kon make dem dey kut wood and karry wota for di kommunity and for God altar. Till today, dem still dey do dis work for where God choose sey, make dem dey woship am.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ