Jeshua wey kom from Levi tribe, en sons and family membas, Kadmiel and en sons (wey bi Hodevah family) join ribuild di temple. (Henadad family wey bi Levi pipol, help dem too.)
Den wi kon go di temple for di fourt day, measure di gold, silva and di oda tins kon gi-am to Priest Meremot wey Uriaya born. Eleazar wey bi Finehas pikin and two Levi pipol; Jozabad wey Jeshua born and Noadaya wey Binnui born, dey der with am.