Dis na di names of di men wey marry wimen from anoda kountry: From di priests akordin to dia family: From Jeshua and en brodas Jehozadak family: Maaseaya, Elieza, Jarib and Gedalaya.
Jeshua wey kom from Levi tribe, en sons and family membas, Kadmiel and en sons (wey bi Hodevah family) join ribuild di temple. (Henadad family wey bi Levi pipol, help dem too.)
Naw di remainin Israel pipol, di priests, Levi pipol, doz wey dey guide, sing and work for di temple and evribody wey obey God law kon separate demsef from doz strenjas wey dey stay for di town. Both wi, awa wifes and shidren wey don get sense to undastand,