Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Ezra 2:1 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

1 Dis na di pipol wey from Babilon go back to Jerusalem and Judah. And each of dem go back to en town. Dia family dey Babilon since King Nebukadnezzar take dem go der as prisonas.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Ezra 2:1
27 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Nebuzaradan karry all di remainin pipol wey dey di town and doz for wildaness wey run from King Nebukadnezzar, plus evry oda pesin go Babilon.


Dem rite Israel pipol name akordin to dia family for Israel kings history book. Dem karry Judah pipol go sofa for Babilon, bikos of dia sins.


Doz wey first kom back to dia land na: di priests, Levi pipol, doz wey dey work for di temple and some few Israel pipol.


Evritin kon bi 5,400 gold, silva and oda tins and Sheshbazzar karry dem follow body as en and di pipol dey komot from Babilon go Jerusalem.


Dia leaders na Zerubabel, Jeshua, Nehemaya, Seraya, Reelaya, Mordekai, Bilshan, Mispar, Bigvai, Rehum and Baanah. Dis na di list and di nomba of pipol from each family for Israel wey kom back from Babilon:


Di priests, Levi pipol and some of di pipol, di singas, di temple guards and di temple workers stay for di town wey dey near Jerusalem; while di remainin Israel pipol stay for di towns wey dia grand-grand papa stay before.


Awa oga, wi wont make yu know sey wi go Judah aria kon si sey dem dey build di great God Temple with big-big block kon use iron wood take do pilas for di wall. Dem dey do di work with kare and e dey go well.


But na for Ekbatana town for Media aria naim dem for si one book wey get dis rekord:


All di pipol wey kom back from Babilon bring ofrin wey dem won sakrifice give Israel God. Dem offa 12 bull for Israel pipol, 96 ram and 77 lamb; dem still offa 12 goat to klean demsef from sin. Dem burn all dis animals as sakrifice give God.


Di priests and Levi pipol wey kom back from Babilon with Shealtiel pikin Zerubabel and Jeshua wey bi di High Priest na: Seraya, Jeremaya, Ezra,


Dis tin happen for di time wey King Zazes dey rule. (I dey tok about di Zazes wey rule more dan 127 kountries, from India go rish Ethiopia).


sey make dem go bring Kween Vashti and make e wear en royal crown. Di kween fine well-well and di king won use am take make yanga for en ofisas and doz wey e invite.


and for di third year wen e dey rule, e kon do party for all en ofisas and savants. Di sojas for Persia and Media dey der too, with di ofisas and strong men for di kountries.


Di drinks many well-well; di king don orda en savant sey make evribody chop and drink until dem taya or beleful.


Dis tin happen for di twenteth day for di third mont wey bi Sivan. Mordekai koll di king seketry and dem take all di leta wey Mordekai rite go give Jew pipol, ofisas and di govnor for di 127 aria for di kingdom wey start from India go rish Kush. Dem rite dis kommand go give di pipol for dia aria akordin to di language wey dem dey speak.


So naw, make una komot from Babilon, make una run komot from der! Make una shaut with joy as una dey tok about am. Make una tell evribody for di world sey, ‘God don save Jakob en savant.’


I go take Israel pipol go back to dia land. Dem go chop from Mount Karmel and Bashan. Dem go chop beleful for Efraim hill and Gilead land.


Dem karry Judah pipol go Babilon as slave kon dey sofa dem. Na anoda land dem dey stay and dem nor get peace at-all. Even with di pain wey dem dey pass thru, evribody wey porshu dem, katch and ponish dem.


Jerusalem enemies don turn dia oga naw and dem dey prosper, bikos God ponish Jerusalem pipol for di sins wey dem kommit. Dem don katch and take dia shidren go far land.


Jerusalem pipol, God nor go ponish una again, instead E go take una komot from Babilon go back to una own land. But una wey kom from Edom, make una nor worry, God go ponish una, bikos of una sins.


Doz wey remain for Judah go stay for der. Dem go stay and dey chop for di house wey Ashkelon pipol run leave. Oga God go visit en pipol with kindness and make dem prosper again.


Wen di govnor don read di leta, e ask dem where Paul from kom. Wen e hear sey e kom from Silisia,


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ