So, dem send message go evriwhere for Israel; from Beersheba go rish Dan kon koll all di pipol sey make dem kom do Israel pipol God, Passova Feast for Jerusalem, bikos dem neva koll all di nashon kon do am before, just as dem rite am for di law.
For di first year wey King Cyrus for Persia dey rule, God make wetin E tok thru Profet Jeremaya happen. E make King Cyrus rite, send and read dis kommand for evriwhere for en kingdom, so dat evribody go hear:
Den e get up from di temple front kon enter Jehohanan wey bi Eliashib pikin room. E dey der thru-out dat nite dey kry for di pipol sin. E nor chop or drink anytin.