Naw wi must make promise give awa God sey wi go send doz wimen and dia shidren go. Wi go do anytin wey yu and di odas wey dey respet God advise sey make wi do. Wi go do wetin God law kommand.
join hand with awa leaders kon swear sey, make curse dey awa head if wi nor live akordin to God law. Di law wey E give us thru en savant Moses wen e sey make wi obey evritin wey di Oga awa God kommand us kon keep all en rules and regulashons.
Di ofisas and doz wey get money kon ansa, “Wi go do as yu tok. Wi go give dem dia propaty and nor kollect wetin dem dey owe us.” Den I koll di priests kon make di ofisas and doz wey get money swear for dia front, so dat dem go keep di promise wey dem just make.