Ezra 10:18 - Holy Bible Nigerian Pidgin English18 Dis na di names of di men wey marry wimen from anoda kountry: From di priests akordin to dia family: From Jeshua and en brodas Jehozadak family: Maaseaya, Elieza, Jarib and Gedalaya. အခန်းကိုကြည့်ပါ။ |
So dem start work for di sekond mont for di year afta dem kom back to Jerusalem where di temple dey. Zerubabel wey Shealtiel born, Jeshua wey Jozadak born, plus all di pipol, di priests and Levi pipol wey kom back from Babilon kon join do di work. Dem put Levi pipol wey don rish twenty years or wey don old pass dat age small make dem dey supavise di work.
Afta dem don do all dis tins finish, some among Israel leaders kom meet and tell mi, Di pipol, di priest and Levi pipol neva separate demsef from di pipol wey dey di kountries wey near dem. Dem still dey do tins with Ammon, Moab, Egypt, Kanaan, Hit, Periz, Jebus and Amor pipol. Dem dey do di same yeye tins wey doz pipol dey do.