Di pipol wey kom back from Babilon asept di plan, so Priest Ezra kon choose some men from among di leaders den rite dia names down. So dem sidan togeda for di first day for di tent mont kon tok about di matter
Dis na di names of di men wey marry wimen from anoda kountry: From di priests akordin to dia family: From Jeshua and en brodas Jehozadak family: Maaseaya, Elieza, Jarib and Gedalaya.