Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Ezra 10:11 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

11 Naw, make una konfess una sins give di Oga wey bi una grand-grand papa God kon start to do wetin go make belle sweet am. Make una separate unasef from doz strenjas wey dey for awa land and drive all una wife wey nor kom from Israel tribe.”

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Ezra 10:11
24 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

King Hezekaya show sey e happy well-well as Levi pipol use all dia mind dey serve God. Dem do di feast for seven days, dey give ofrins and dey tank God wey bi dia grand-grand papa God.


Priest Ezra stand up kon tell dem, “Una don kommit strong sin as una go marry doz wimen wey bi strenjas. Una don add join Israel wahala.


So di pipol shaut ansa, “Wi go do anytin wey yu tok.


Naw wi must make promise give awa God sey wi go send doz wimen and dia shidren go. Wi go do anytin wey yu and di odas wey dey respet God advise sey make wi do. Wi go do wetin God law kommand.


Afta dem don do all dis tins finish, some among Israel leaders kom meet and tell mi, Di pipol, di priest and Levi pipol neva separate demsef from di pipol wey dey di kountries wey near dem. Dem still dey do tins with Ammon, Moab, Egypt, Kanaan, Hit, Periz, Jebus and Amor pipol. Dem dey do di same yeye tins wey doz pipol dey do.


Wen Israel pipol hear dat part for di law, dem nor kon add all di strenjas for di town join.


Dem don already separate demsef from all di strenjas. Dem wear sak klot kon pak dust for dia head as sign sey dem dey sorry. Den dem kon stand dey konfess dia sins wey dem and dia grand-grand papa don kommit.


So, I konfess all my sins kon stop to hide all di bad tins wey I dey do. I tell mysef sey, “I go konfess my sins to God.” And E really forgive mi!


Yu nor go ever susid for life if yu try to hide yor sin. Konfess and stop to do dem and God go show yu mesi.


God dey tell dat kind man sey, “If yu honor and keep di Sabat Day; kon do wetin I wont and keep my kovenant,


But make una first gri sey una don sin against mi wey bi di Oga una God. Make una konfess sey una nor dey obey my kommand and una don show una love to oda gods for under evry green tree.” Mi, wey bi God, don tok.


Oga wey bi Israel God wey dey rule all of us sey, Make una shange from di kind life wey una dey live kon do di rite tin. If una shange, I go allow una stay for dis land.’


“Naw, mi wey bi God wey get pawa dey tell Israel pipol sey I go judge evribody akordin to wetin e do. So make una turn from sin and all di bad tins wey una dey do, so dat una sins nor go distroy una.


So dem koll di man again kon tell am, “Make yu promise before God sey yu go tok di trut, bikos wi know sey di man na sina.”


Make una nor bi like pipol for di world, but make una allow God shange una mind, den una go know how to serve God and do tins wey dey make belle sweet am.


Christ still sey, “Make una kom out and separate unasef from dem,” and “Make una nor tosh anytin wey nor dey klean, den I go welkom una


den una life go betta just as Christ wont. For all di good tins wey una dey do, make una dey bear fruit and learn to know God more-more.


make E give una evritin wey una nid to do wetin E wont. Anytin wey good for en eye, make E do am inside us thru Jesus Christ. Make all glory bi Jesus Christ own forever and ever. Amen!


So Joshua kon tell Akan, “My pikin, respet Israel God make yu praiz am! Tell mi wetin yu do; nor deceive mi at-all!”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ