5 Di head for each family for Judah and Benjamin tribe, di priests, Levi pipol and evribody wey God tosh dia heart kon go back to Jerusalem go build God Temple.
To take fulfil wetin God promise Israel pipol thru Profet Jeremaya, God kon make King Cyrus for Persia rite law give all of dem for en kingdom for di first year wen e start to rule.
For di first year wey King Cyrus for Persia dey rule, God make wetin E tok thru Profet Jeremaya happen. E make King Cyrus rite, send and read dis kommand for evriwhere for en kingdom, so dat evribody go hear:
Dis na wetin King Cyrus for Persia tok, Di Oga God for heaven don make mi rule di whole world and E sey make I build temple for am for Jerusalem wey dey Judah.
Anywhere wey Israel pipol still remain, make dia neighbours help dem. Make dem give dem silva, gold, animals and ofrin wey dem go offa for God Temple for Jerusalem.
I nor tell anybody wetin God put for my mind make I kom do for Jerusalem. Den for mid-nite, I wake-up kon take some among my men follow body with only one donkey wey I ride.
So Oga God kon help Zerubabel wey bi govnor for Judah; Joshua wey bi di High Priest and all di pipol wey kom back from Babilon, so dat dem go fit do di work. All of dem kon start to build Oga God temple. Dem start di work