4 Anywhere wey Israel pipol still remain, make dia neighbours help dem. Make dem give dem silva, gold, animals and ofrin wey dem go offa for God Temple for Jerusalem.
I know sey Yu dey test evribody heart and Yu dey like doz wey dey respet diasef. I put my body for groun kon use all my heart take give Yu all dis tins and I don si how all yor pipol dey happy as dem dey give Yu dia gifts.
Imnah pikin Kore, wey kom from Levi tribe, dey guide di east side for di temple and na-im still dey kollect and divide di gifts wey pipol bring kon give God.
Di head for each family for Judah and Benjamin tribe, di priests, Levi pipol and evribody wey God tosh dia heart kon go back to Jerusalem go build God Temple.
Awa Oga wey bi Israel God, Yu dey good. Wi, yor savants wey remain, kom meet Yu and wi dey konfess awa sins. Aldo wi nor get any rite to kom yor present again afta evritin wey wi don do.”
Nobody force Israel pipol as dem dey give dia ofrin to God. Evry man and woman bring as en heart move am to bring, so dat dem go take am do all di work wey God kommand dem thru Moses.