11 Evritin kon bi 5,400 gold, silva and oda tins and Sheshbazzar karry dem follow body as en and di pipol dey komot from Babilon go Jerusalem.
Di sojas oga take all di gold and silva tins with di basins and di tin wey dem dey use burn incense.
Di oda tins na 30 small gold basin, 410 small silva basin and di oda tins to take kook, na 1,000.
Dis na di pipol wey from Babilon go back to Jerusalem and Judah. And each of dem go back to en town. Dia family dey Babilon since King Nebukadnezzar take dem go der as prisonas.
Wen Judah and Benjamin enemies hear sey doz wey kom back from Babilon, dey ribuild di Oga wey bi Israel God Temple,
Di pipol wey kom back from Babilon celebrate Passova for di fourteent day for di first mont.
Wen God take wi en pipol go back to Zion from Babilon, E bi like sey wi dey dream!
My God, Yu don pour blessing and favor put for yor land and give Israel en glory back.
So, make una listin to wetin mi wey bi Israel God wey get pawa dey tok about di betta-betta tins wey remain for Jerusalem temple and palis:
E dey do like dis to show en glory wen E pity for pipol wey E choose to show en glory.