Den I go meet yu for der and from di box kover; between di two angels wey kover di box wey di kommandment dey, I go tell yu all di tins wey yu go kommand Israel pipol.
Den I tell Zedekaya, “Israel God sey, ‘Yu nor go die if yu surenda give Babilon king and dem nor go burn dis town rish groun; both yu and yor family go live.
Na dis pikin bi God image and e dey show God glory. Naim dey keep evritin wey dey dis world with en pawa. Afta e don die make God for forgive evribody dia sins, e kon go sidan for God rite side for heaven.