9 I nor go sorry for una or show una mesi. I go ponish una for di bad tins where una don do, den una go know sey na mi bi God and na mi dey ponish una.”
Even with all dis ponishment from God, Israel pipol nor gri turn from sin go meet di Pesin wey go save dem. Dem nor even tink to setol with di Oga God wey dey lead heaven sojas.
E go skata dem like pot wey fall press each oda kon break. Na so too shidren go bi to dia papa and mama. I nor go pity or sorry for dem. I must distroy dem and nor-tin go fit stop mi.”
Naw, mi, God promise sey, “King Zedekaya with en ofisas and doz wey survive di war, di honga and diziz, I go give dem to King Nebukadnezzar for Babilon and to dia enemies wey won kill dem. King Nebukadnezzar go kill dem with swod and e nor go pity or sorry for dem at-all.” ’ ”
I go ponish yu, yor shidren-shidren and all yor ofisas, bikos of di sin wey all of una kommit. Yu or Jerusalem and Judah pipol nor gri listin to my warnin. So I go bring di wahala wey I bin tell una about, kom.’ ”
But na God do wetin E plan. E don do wetin E promise and E warn us about am since. E nor sorry for Jerusalem kon distroy am. E give awa enemies viktory and dem dey happy, bikos God don distroy us.
“So as long as mi God dey alive and as una don spoil my temple with una juju and all di bad tins wey una dey do, I nor go sorry for una wen I dey distroy una.
E nor go tey before una go feel as my vexnashon strong rish. I go judge una akordin to wetin una do and I go pay una back for all di wiked tins wey una do.