7 Una wey dey di land, wahala dey kom meet una. Di time go soon rish wen una nor go dey do party for di juju house wey dey di mountin, but na so-so kry una go dey kry.
For morning, di angel kon tell Lot, “Make una dey go! Lot! Karry yor wife and shidren komot kwik-kwik, if not, wen God dey judge di town, dem go distroy una join!”
Nobody get joy or dey happy and inside di vineyard; nobody dey dance or shaut; no grape even dey to press to make wine, bikos I don end dia shaut for joy.
But awa Oga God wey dey lead heaven sojas get di day wen E go kause wahala and konfushon for Vishon Valley and evribody go beg make di mountins kom help dem.
My God, Yu don deceive mi! Yu don deceive mi so dat I go bi yor profet? Yu strong pass mi and Yu get pawa well-well. Naw, evribody dey look and laf mi.
So make yu tell dem, ‘Dis na wetin God wey get pawa dey tok: Evritin wey I tok, nor go tey before dem go happen! Evry word wey I tok, go must happen.’ ”
“Na mi God kreate di mountins and breeze. I allow human being know wetin I dey tink. Na mi dey bring darkness to take kover lite and I dey waka on-top di hill. Na mi bi God and na mi get all di pawa.”