So make yu tell dem sey: ‘Dis na wetin God wey get pawa tok: I go stop all di word wey di pipol dey tok and dem nor go tok like dis for Israel again.’ But make yu tell dem, ‘Di day don rish wen evry vishon wey dem tok, go happen.
Una wey dey di land, wahala dey kom meet una. Di time go soon rish wen una nor go dey do party for di juju house wey dey di mountin, but na so-so kry una go dey kry.
God kon ask mi, “Amos, na wetin yu dey si?” I ansa, “Na basket wey fruit full.” Den God tell mi, “Di end don kom for my pipol, Israel. I nor go shange my mind again and I go ponish dem.
God nor sorry for di world wey dey before and E distroy am with wota, but save Noah wey prish make pipol do wetin good for God eye and di seven pipol wey dey with am.