Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Ezekiel 7:5 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

5 Dis na wetin God wey get pawa tok: “Israel pipol, I go ponish una well-well.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Ezekiel 7:5
15 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Doz wey dey like to sin, na trobol dey porshu dem, but na blessing, raitious pipol go gain.


bikos no matter how many times good pipol fall; dem dey always get up again; but trobol dey distroy wiked pipol.


So I ansa, “Morning dey kom, but nite go kom again. So if yu won ask again, wen dat time rish, make yu kom back kon ask.”


“God sey, ‘Judah king and Jerusalem pipol, make una listin to wetin mi, Israel God wey dey mighty, dey tok: I go bring wahala kom dis place and anybody wey hear about am, go fear!


Bikos of all di tins wey una do; tins wey I hate well-well. So I go ponish Jerusalem as I neva do before, but I nor go ponish dem like dat again.


Di time don rish! Di day don kom. Naw, doz wey dey buy nor dey happy and make doz wey dey sell, mourn, bikos God go ponish evribody.


“Man pikin, dis na wetin mi wey bi Oga God dey tell Israel pipol. Di end don rish for evriwhere for di land!


Yu don do wetin Yu sey Yu go do wi and awa leaders. For all di towns wey dey for dis world, na Jerusalem Yu dey ponish pass.


God day don near, di day wen di Almighty go distroy evriwhere. Dat day go bad well-well!


“Out of all di families for di eart, na only una I know and kare for and bikos of dis, I go ponish una for all una sins.”


Wetin make una dey plan against God? Na wons E go distroy una finish and trobol nor go happen for di sekond time!


Una gold and silva nor go save una wen God go show as E dey vex rish. En jealousy bi like fire and di fire go distroy di world. Yes, na God make evribody for di world dey fear.


bikos for dat time, di sofa wey go dey, go strong pass any sofa wey don happen since wen God kreate di world kom rish naw and dis kind sofa, nor go dey again.


I go revensh and pay dem back wen dem go fall, bikos di day wen wahala go kom meet dem, don near well-well and dia judgement don almost full!”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ