1 God sey, “Man pikin, use sharp knife take kut yor hair and bear-bear. Put di hair for skale kon divide am into three part.
“Make priest nor barb en hair or let am grow too mush. Dem must let am grow rish one stage kon maintain am like dat.
Wen dat time rish, God go bring di pesin wey dey barber hair for Eufrates side, wey bi Assyria king and e go kut di hair wey dey una face, head and body komot.
Make di priest nor barb any part for en head, shave en bear-bear or kut en body.
Tekel (weigh) mean sey: ‘God don weigh yu for skale kon si sey yu dey lite.’
God tell Jeremaya, “Make yu take some leaders and priest go buy pot wey dem take klay make.
God sey, “Man pikin, make yu take one stone kon put am for yor front den draw Jerusalem put.