E go bi di holy part for di kountry and na di priests go enter inside go serve God for en temple. Dia house go dey inside di kompond and my temple go dey der too.
Dis holy aria go bi for di priest wey bi Zadok shidren-shidren. Na dem dey serve mi and dem nor join Israel pipol sin against mi, just as Levi tribe do.
“Levi shidren go get special place for der and e go dey di sout-side near di priests. E go long rish nine mile kon wide like three and kwota mile for west; di measurement na di same from nort go rish di sout-side.