God kon sey, “From naw go, dem nor go ever open dis gate and as e dey so, na so e go dey. Dem nor go let human being use am, bikos mi di Oga wey bi Israel God, don pass am enter. E must dey klose like dat forever.
Den di man take mi pass di gate for nort go di temple front. As I still dey look, I kon si God glory dey shine for di temple. At wons, I fall face groun
Den di man bring mi kom di temple front and I si wota dey kom out from under di gate dey rush go east; di place wey di temple face. E dey flow well for di sout-side for di temple near di altar.
As di man waka go di east side with en tape, e measure 1,000 and seven hundred and fifty fit, and e sey make I waka pass am. Di wota rish mi for my leg.