9 and one room dey to pass enter di sout-side for di temple too. I si sey di road to go di building so, wide rish eight fit
Between di road and di building wey di priest dey use, e get one open space wey almost wide rish nine fit.
Di man measure as di temple wall bi and e tick rish ten fit. Round di wall for di temple, small-small rooms dey wey wide rish seven fit.
Den di man take mi go di kourtyard for outside and wi pass di building for di nort side for di temple wey nor far from di one wey dey di west side for di temple.
For di nort side, dis building passage wide pass seventeen and half fit.