Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Ezekiel 38:9 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

9 Yu, yor sojas and all di many kountries wey dey with yu go attack Israel like betta strong rain and una go bi like kloud wey kover di eart.”

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Ezekiel 38:9
12 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

bikos na Yu dey protet poor pipol and doz wey nor get anytin. Yu dey protet dem from rain kon kover dem from hot sun, bikos di way wiked pipol dey bihave, bi like heavy rain wey dey fall.


Si! God dey send one strong pesin wey get pawa well-well kom attack una. Di pesin go kom like heavy rain kon attack and distroy una with una land.


Dem sharp dia arrow well and dia bows don ready to shot. Dia horse dey make nois like stone wey dem nak togeda and dia shariot taya dey turn like strong breeze.


Yes, di enemies go kom like kloud. Dia shariot bi like strong breeze and dia horse fast pass eagle.” Den I kon kry, “Wi don die finish o-o, bikos dem go distroy us!”


So make yu go tell di profets sey dia wall go fall. I go send rain with big-big stone kon fall on-top am and betta strong breeze go blow am trowey.


Darkness go kover Tahpanhes town wen I break and end di pawa wey Egypt get, wey make dem dey make mout and karry body up. Kloud go kover Egypt and all di pipol wey dey inside. Den sojas go katch and karry all of dem go prison.


Yu and yor pipol go attack my pipol like strong kloud wey dey pass di land. Wen di time don rish, I go send yu go skata my land, so dat dem go know who I bi and dem go si as I holy rish, bikos of di tins wey I go do thru yu.


“Wen di end don rish, Egypt king go attack am. Siria king go fight am with all en pawa; with shariot and many ship. E go attack and distroy many kountries like river wey flow enter land.


For dat day, darkness go kover di land and kloud go full evriwhere! Strong-strong sojas go kom and dem go bi like darkness wey spread kover di mountins. Dis kind tin neva happen before and sometin like dis nor go ever happen again.


Dem go waka round di world and where God pipol dey stay and di town wey evribody love, fire go kom down from heaven kon burn am finish.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ