1 God sey, “Man pikin, make yu chop dis book; den go tok to Israel pipol.”
E sey, “Man pikin, I dey send yu go meet Israel pipol, bikos dem don turn from mi and still dey do bad tins, just as dia grand-grand papa do.
Den I kon rish Tel-Abib wey dey near Chebar River, for where di prisonas dey stay and I kon stay der for seven days, but di tins wey I si and hear, fear mi well-well.
Make yu dey learn dis tins; dey do am with all yor mind, so dat pipol go si as yu dey progress.
Den I sey, ‘Na mi bi dis, God na wetin yu wont I kom do, just as yor word tok about mi for Moses Law.’ ”