“Israel pipol, dis word wey una dey always tok for dis land, na wetin e mean? Una dey sey, “ ‘Mama and papa dey chop grape wey don sawa, but na di shidren dey feel di sawa taste for dia mout.’ ”
“Naw, mi wey bi God wey get pawa dey tell Israel pipol sey I go judge evribody akordin to wetin e do. So make una turn from sin and all di bad tins wey una dey do, so dat una sins nor go distroy una.