Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Ezekiel 17:3 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

3 tell dem sey di Oga God wey get pawa well-well sey: “One big eagle wey get fine and long feadas, fly go Mount Lebanon kon break di branches wey high pass for one cedar tree komot,

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Ezekiel 17:3
20 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Afta King Nebukadnezzar for Babilon don karry Jehoiakim pikin Jekonaya, wey bi King for Judah, en ofisas and all di pipol wey get handwork go Babilon, God kon show mi two basket wey fig fruit full for di temple front.


Yes, di enemies go kom like kloud. Dia shariot bi like strong breeze and dia horse fast pass eagle.” Den I kon kry, “Wi don die finish o-o, bikos dem go distroy us!”


God don promise sey, “One nashon go rush kom Moab land like eagle wey spread en feada


Una pride don deceive una. Nobody dey fear una as una tink. Una dey stay for rock and on-top mountin a nd even doh una house high like eagle own, God go bring una kom down.” Dis na wetin Oga God tok.


Doz wey dey porshu us, fast pass eagle wey dey fly for sky. Dem porshu us pass di mountin kon set trap for us for wildaness.


den e karry am go where pipol for dey do business kon plant am for der.


Anoda strong eagle wey get big and tick feada dey. Naw, di rut and leaf for di vine face dis eagle, bikos di vine bilive sey di eagle go gi-am more wota pass di one wey di gardin dey give,


Una bi like cedar tree for Lebanon wey get betta shape, fine-fine branches and wey tall rish di kloud.


E don make yu ruler ova human being, animals and birds for dis eart. Na yu bi di head among all gold.


na yu, my king! Yu don dey big and strong; yu don big sotey yu dey rish di heaven and yor pawa rish di end for di world.


“Di first one bi like lion wey get eagle feada. As I dey look am, dem remove di feadas kon karry am komot groun. Dem make am stand with two leg like human being kon gi-am human being mind.


“Blow di trumpet! Enemies dey rush dey kom attack my pipol like eagle! My pipol don break di kovenant wey I make with dem kon go against my laws.


Dia horse fast pass leopard and e wiked pass wolf for desert. Dia men dey ride di horse kom; dem bi like eagle wey dey rush go kill en enemy.


Bikos na where dead body dey, na der vultures dey gada put.”


So di news about Jesus kon spread go evriwhere for Siria. Dem kon bring pipol wey nor well, wey nor fit waka, pipol wey devil dey worry and di pipol wey demon dey inside dem, kom meet am and e heal all of dem.


God go bring some pipol from far against una and dem go kill una like vulture. And dem bi pipol wey una nor go undastand wetin dem dey tok;


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ